Tuesday 28 August 2012

i haf back!

yes, i haf back from hexile. since i away many many plenty tins e haf happen. GEJ haf do many silly tins, plane haf crash, motor e haf kee people, and i haf get new son. Naija haf suffer no be small. dey haf catch tiffs and release dem again. dey haf also put two different people for display for dsame atrocity! boko haram haff cause kasala for town, and nepa haf finally reach 4 thousand of megawatt! no be small tin o. jonah wife is now fist lady slash perm sec. efun Sanusi haf plan N5000 note but senator people haf say no, e no want, e stupid idea. GEJ efun say we naija people we praise him afta him tenure finish. ah, i fear for dat one o, mayb he wee go for third term. by den i go dey blog from Togo. cashya later. make i go piss.